Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 16:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 16:3
20 Iomraidhean Croise  

Jew men dey marry wimen wey bi strenjas, so dem don dirty God pipol wey dey holy and na di leaders and ofisas dey do dis tins pass.


Di pipol for di kamp kon dey jealous Moses and Aaron wey bi God priests.


Wen Oga God appear to en pipol for Mount Sinai, E kom with angels and shariot wey nobody fit kount.


Una go bi my kingdom priests and holy nashon wey dem dedikate give mi.’ Dis na wetin yu go tell Israel pipol.”


Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem.


So, na God una dey gada against! Who Aaron bi wey una dey komplain about?”


But for di next day, di whole kommunity kon dey komplain against Moses and Aaron sey, “Una don kill God pipol.”


Una go lite fire, put incense inside, den karry am go di altar. Den wi go si di pesin own wey God go take. Levi pipol, na una own worse pass!”


Wahala nor go happen to Jakob shidren; Israel pipol nor go si trobol. Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem and na-im bi di king.


Israel pipol, make una nor spoil di land wey I dey give una, bikos na mi bi God and I dey stay among una.’ ”


Weda dem bi man or woman, una must porshu dem komot from di kamp, so dat dem nor go make di kamp unklean, bikos God dey stay der with en pipol.’ ”


But una papa nor gri obey am. Instead, dem nor ansa am, but dem shange dia mind sey dem won go Egypt back.


“Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan