13 Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant?
Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”
But di pipol dey hongry to drink wota, so dem still komplain, “Wetin make yu take us komot from Egypt? Na to kill wi, awa shidren and awa animals with honga?”
Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?” Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.”
Some of una nor dey beleful; even doh una dey chop betta grass, una still dey mash wetin una chop remain! Una dey drink klean wota kon dirty di ones wey una drink remain!
but na for one full mont. Una go chop am until meat go kom out from una nose kon make una dey sick, bikos una rijet God wey dey among una kon dey komplain sey, ‘Wi nor for komot from Egypt o-o.’ ”
Some yeye pipol wey travel with Israel pipol, get long-trot for meat and dem kon make Israel pipol dey komplain sey: “How wi wish sey wi fit just get some meat chop!
Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?”
“Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.