Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin.
Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.
With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine.
Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont