Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 15:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 den di one wey dey give en ofrin to God must go bring each animal with one kilogram of flower wey dem mix with one lita of olive oil for korn ofrin,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 15:4
21 Iomraidhean Croise  

Yu must spend di money well kon buy bulls, rams, lamb, korn and wine, den make yu offa dem for di altar for di temple wey dey Jerusalem.


Dis na di tin wey yu go offa give mi with di first lamb: yu go offa am with di Tabanako efah wey get fine flower wey dem mix with one kwota of oil wey dem press komot from some olives and one kwota of wine as drink ofrin.


Just as Israel pipol dey bring rice ofrin kom di temple with fine kontaina, na so too dem go bring all una men from all di nashons kom give mi as ofrin for my holy mountin. Dem go karry dem kom my holy hill for Jerusalem with horse, melu, kamel, shariot and truck.


Una go still dey give mi five pound of flower evry morning with one kwota of olive oil wey dem mix with flower. Una must kontinue to give dis ofrin forever.


Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs, den di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.


“For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.


“ ‘Wen una dey give korn ofrin to God, una must first grind am to powder. Una must put olive oil and incense on-top


Make una put olive oil and incense on-top.


With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine.


If una give sheep as ofrin, una must gi-am for God present.


“ ‘Dis na di law for korn ofrin. Aaron sons go present am before God for di altar front


God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.


Una go add all dis tins join di korn ofrin wey dem mix; six kwota of flower with each melu, four kwota with each ram and


Make una give di first lamb for morning and di sekond one for evening,


Make una give dis plus di normal burnt ofrin for di first day for di mont with en korn ofrin; di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin. Dis food ofrin get betta smell wey God like well-well.


En ofrin na one silva plate wey heavy rish one hundred and three shekel and one shine-shine silva bowl wey heavy rish seventy shekel, but na akordin to di sanctuary shekel. Each of dem go plenty with fine flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin;


naim make am choose mi to bi Jesus Christ savant for Gentile pipol and make I for dey prish di Good News. Dis tin happen, so dat di Holy Spirit go make God dey happy with Gentile pipol.


Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.


“But di olive tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my oil wey dem dey use take dey honor gods and human being, just bikos I won bi king!’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan