3 make una give mi one melu, one ram, one sheep or goat as burnt ofrin. Nor bi sakrifice to pay una vow or free will or first ofrin; put na ofrin wey God like en smell,
Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.
Den di sekond lamb wey yu go offa for evening; yu go prepare am like di morning own, with drink ofrin wey get betta smell; ofrin wey dem make with fire for God.
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen man don give ensef to God to take fulfil di special vow wey e make, di pesin go dey free afta e don pay dis money,
“If anybody bring peace ofrin to take pay en vow or e do am from en mind, nor bi all of dem una go chop di day wey e gi-am, but dem fit chop di remain wons for di next day.
Make una give burnt ofrin, di kind smell wey God like well-well, dat is: two yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
Dem go still give one basket wey bread wey dem nor make with yist full: kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil and biscuit wey dem take olive oil rub plus di korn ofrin and di wine wey dem nid.
To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins?
una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.