Den, David orda Joab and en men sey make dem tear dia klot kon wear sak klot take mourn for Abner. King David follow Abner koffin for back wen dem dey go beri am.
Judah men kom meet Joshua for Gilgal and Kaleb wey Jefunneh wey kom from Kenizz born kon tell Joshua sey, “Yu know wetin God tell Moses en savant for Kadesh Barnea about yu and mi.
Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! Yu don distroy mi! Yu don kause wahala for mi! I don make vow give God and I nor go fit take am back.”