9 from Benjamin tribe, e send Palti wey Rafu born;
from Zebulun tribe, e send Gaddiel wey Sodi born;
from Efraim tribe, e send Hoshea (Joshua) wey Nun born;
Make una dey strong and make una heart nor shake; make una nor fear dem at-all, bikos na di Oga una God dey go with una. E nor go leave or forget una.”
God go-go for yor front. E go dey with yu; E nor go leave or forget yu. Make fear nor katch yu and make di work nor taya yu.”
Make una nor fear. Make una remember wetin di Oga una God do to Fero and Egypt pipol;
So make una nor fear doz kountries, bikos di Oga una God dey with una and E bi God wey dey great and wonderful.