4 Na dia names bi dis: From Reuben tribe, e send Shammua wey Zakkur born;
As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:
Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.
Israel sons na: Reuben, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Zebulun,
“Naw, dis na di tribes name: From nort near Hetlon to Lebo-Hamat go rish Hazar-Enan (wey bi Damaskus boundary near di nort side for Hamat) wey wide from east go rish west. Dan tribe go get one part.
So Moses send dem komot from Paran Wildaness, just as God kommand. All di men wey e send, na leaders for Israel.
from Simeon tribe, e send Shafat wey Hori born;
Di men wey Moses send go shek di land, wey kom back kon make Israel pipol dey komplain against God, bikos of di bad tin wey dem tok about di land;
Why una won diskorage Israel pipol make dem nor cross Jordan River go di land wey God don give dem?
Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born;
Dem mark 12,000 from Judah tribe, 12,000 from Reuben tribe, 12,000 from Gad tribe.