Dis na wetin God tok about Damaskus: “Di pipol for Hamat and Arpad town dey worry and dem nor get rest, bikos dem hear bad news. Dia mind dey trobol dem like river and dem nor fit rest.
Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?
Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”
Nobody dey to save dem, bikos dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor get any business with oda pipol. Den, Dan tribe build di place kon dey stay der. And dis tin happen for di valley near Bet-Rehob.