So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”
Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.
“Make yu send men go shek Kanaan land wey I won give Israel pipol. Yu go send one man from each of di twelf tribe. Make each one bi leader for en tribe.”
“Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.