Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 12:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 12:8
39 Iomraidhean Croise  

So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”


Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.


I go listin to many proverbs and play jita take solve many problems.


Wen dem blow di horn well-well, Moses start to tok and God kon dey ansa am.


Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota.


God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.


God ansa, “I go make all my goodness pass yor front and I go announce my name as Oga God to yu. I go show kindness to who I choose and I go show mesi to who I like show am to.”


Den I go take my hand komot and yu go si my back, but yu nor go si my face.”


Wen Aaron and Israel pipol look Moses face, dem si sey e dey shine and dem kon dey fear to near am.


so dat dem go fit undastand proverbs, parabols and wetin wise pipol dey tok.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


God sey, “Na who una fit take kompare mi? Make una tell mi, abi e get anybody wey fit bi like mi?


“Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol;


But I tell God, “Oga God wey get pawa, nor let mi do like dis, bikos di pipol don already dey komplain sey dem nor undastand wetin I dey tok.”


Na profet God take save Israel pipol from Egypt where dem bi slave and na profet e take guide dem.


Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem.


Naw, wen Moses don enter di tent, God kon tok to am for di Kovenant Box top; between di two image wey bi like angel wey dem dey koll cherubim.


E do am so dat wetin di profet tok, go happen: “I go open my mout tok parabol, I go tok evritin wey bi sekret since God kreate dis world.”


Jesus tell en disciples, “Anybody wey listin to una, don listin to mi and anybody wey rijet una, don rijet mi and God wey send mi.”


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.


If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.


Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.


All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.


Di Oga una God go raiz profet like mi from among una and e go bi una own kountry man and make una listin to am.


E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face.


But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.


Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota.


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.


Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!


Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets,


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,


Like dis too, dis men wey sey dem dey dream; dey live bad life; dem nor dey obey God authority and dem even dey curse angels wey get glory.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan