Den Rebekah tell Isaak, “I nor dey happy bikos of dis Het dotas. E betta make I die, instead of Jakob to marry one among dis Het dotas wey dey dis land!”
Fero kon koll Josef, Zafenat-Paneah. E still gi-am Asenat wey bi Potifara dota, priest for On, so dat di woman go bi Josef wife. So Josef kon dey kontrol di whole Egypt.
non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.
Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.