34 As dem dey travel, God kloud dey kover dem.
Yu lead yor pipol with kloud for day time and fire wey go dey give dem lite for nite.
Yet Yu nor still leave dem for inside desert, bikos yor mesi, dey great. Yu nor remove di kloud and fire wey dey show dem lite, both for day and nite.
God kover Israel pipol with kloud kon give dem big fire as lite for nite.
God kloud dey-dey di Tabanako for day time and na fire e dey bi for nite and evribody for Israel dey si am as dem dey travel.
And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey, “My God! Arise make yor enemies dem skata and make all doz wey hate Yu, run as dem si Yu dey kom.”