Nombas 10:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English14 Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem. Faic an caibideil |
Naw, di men wey go help una, na dia names bi dis: from Reuben tribe, Elizur wey Shedeur born; from Simeon tribe, Shelumiel wey bi Zurishaddai pikin; from Judah tribe, Nahshon wey bi Amminadab pikin; from Issakar tribe, Netanel wey Zuar born; from Zebulun tribe, Eliab wey bi Helon pikin; from Josef sons: from Efraim tribe, Elishama wey bi Ammihud pikin and from Manasseh tribe, dem pick Gamaliel wey Pedahzur bi en papa; from Benjamin tribe, Abidan wey Gideoni born; from Dan tribe, Ahiezer wey Ammishaddai born; from Asher tribe, Pagiel wey Okran bi en papa; from Gad tribe, Eliasaf wey Deuel born and from Naftali tribe, dem pick Ahira wey bi Enan pikin.”