Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 1:51 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

51 Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 1:51
15 Iomraidhean Croise  

At wons, God vex well-well for Uzza kon kill-am, bikos e nor respet God and Uzza die near di box.


For di nomba twenty day, for di sekond mont, for di sekond year, afta di pipol don komot from Egypt, di kloud kon komot from di Tabanako for di Kovenant Box.


Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.


If anybody wey go near God Tabanako, go die, dat mean sey all of us don die finish?”


And di man stik wey I go choose go prosper; so I go stop Israel pipol to dey komplain against yu.”


Di oda Israel pipol nor go kom near di tent where dem for dey do meetin again, or dem go bear dia sin and dem go die.


Dem must kare for yu and di whole Tabanako. But dem must nor kom near di holy tins for di Holy Place and di altar or all of una go die.


Dem must work with yu kon kare for di tent where dem for dey do meetin and for all di work wey dey di tent, but anybody wey nor kwalifai, make e nor work with yu.


But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”


So yu go choose Aaron and en sons kon make dem do di work wey priests dey do; anybody wey try to do dia work for dem, make dem kill-am.”


But di pipol wey go stay for di Tabanako front for east wey face di tent where dem for dey do meetin, na Moses, Aaron and en sons. Na dem go kare for di tins wey dem nid for di Holy Place and wetin Israel pipol wont. But if anybody wey nor suppose go der, go der, dem go kill-am.


But God kill some of Bet-Shemesh pipol, bikos dem go look inside di box; pipol wey God kill na 50,070. Di pipol kry, bikos God kill dia pipol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan