Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Nombas 1:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Make una take one man from each tribe and e must bi oga for en family, so dat dem go help una.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Nombas 1:4
19 Iomraidhean Croise  

Solomon koll all di leaders for Israel tribe and villages kon tell dem, “Make una karry God Kovenant Box go di temple for Zion wey bi David Town.”


But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.


Moses choose men wey fit do di work among Israel pipol kon make dem oga ova di pipol. Some dey rule tazons, odas hundred, some fifty and some ten.


Na dis ones dem choose from di kommunity, as leaders from dia grand-grand papa tribe. Na dem bi oga for all di pipol wey dey Israel.


Dis na di men wey Moses and Aaron kount plus di twelf leaders wey dey Israel, each of dem kom from dia own family.


Den yu must rite Aaron name put for Levi pipol stik; bikos each stik na for di leader for each tribe.


Di Israel man wey dem kill with dat Midian woman, na Zimri wey Salu born, wey bi leader for Simeon tribe.


God tell Moses, “Arrest all di leaders kon hang dem before di Oga for aftanoon, so dat mi God nor go vex for Israel pipol again.”


All di leaders for di tribe, Moses kon tell dem about Israel pipol sey, “Dis na wetin God kommand:


So Moses, Aaron and di leaders kon kount Kohat pipol akordin to dia family and towns,


Den di leaders for Israel, di heads for di tribes kon give one ofrin. Na dis pipol bi leaders for di tribes and na dem dey monitor di kountin.


“So I take di men wey una selet by unasef kon make dem judge and ofisas ova una. Some dey lead 1,000 pipol, some hundred, some fifty, while some na only ten pipol.


Ten leaders follow am go, one from each tribe, dem bi leaders for Israel family.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan