My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.
kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.
God sey, “I go remove di shariot from Israel, den take di horse dem komot from Jerusalem and distroy evritin wey dem take dey fight war. Una king go make peace with oda nashons. E go rule from one sea to di oda: Even from Eufrates River go rish where di eart for end.”