Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Matiu 4:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Den devil kon meet am sey, “If yu bi God pikin, kommand dis stone make e turn to bread.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Matiu 4:3
34 Iomraidhean Croise  

Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”


Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”


Simon Pita ansa, “Yu bi di Mezaya, God Pikin wey dey alive.”


But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


Na so di gospel about Jesus Christ, God Pikin take start.


And anytime evil spirit wey dey inside some pipol body si Jesus, dem go fall for en front dey shaut, “Yu bi God Pikin.”


Den e shaut, “Make yu leave mi, Jesus, yu wey bi God Almighty Pikin! I take God beg yu, nor sofa mi!”


Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin.


All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?” Jesus ansa, “Na una tok am o-o.”


Devil kon tell am, “If na true sey yu bi God Pikin, make yu kommand dis stone make e turn to food.”


Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.


Den devil take Jesus go Jerusalem kon make am stand on-top di place where high pass for di temple kon tell am, “If yu really bi God Pikin, make yu jump go down,


I don si am and I bear witness sey, ‘Dis man na di pesin wey God choose.’ ”


Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”


But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.


Wen Jesus hear sey dem don drive di man komot, e go look for am kon ask am, “Yu bilive who Man Pikin bi?”


At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jesus Christ na God Pikin.


Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.”


I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.


So wen I nor fit bear again, I send pesin make e help mi shek how una faith bi, bikos I dey fear sey devil wey dey tempt pipol, don tempt una and all di work wey wi do among una, don dey yuzles.


Make una make sure sey nobody dey do bad tins or nor dey fear God, just like Esau wey sell en rite as first-born, bikos of food.


Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am.


E nor get papa or mama, e nor get story at-all, en days nor get where e for start or where e go end, but e bi like Man Pikin and e bi priest forever.


But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.


Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan