Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 9:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Den Elijah and Moses kon appear for dia front dey tok with Jesus.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 9:4
15 Iomraidhean Croise  

Before John kom, Moses Law and di profets dey prish about wetin go happen.


en klot kon dey shine well-well and e white pass how any dri-cleaner go fit wosh am.


So, Pita tell Jesus, “Tisha, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.”


Den e kon use wetin Moses and all di profets rite take tell dem wetin God tok about am for en word.


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and odas still sey yu bi one old profet wey wake-up from deat.”


Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,


So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan