Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 9:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Afta six days, Jesus, Pita, James and John kon go one high mountin. E kon shange for dia front,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 9:2
23 Iomraidhean Croise  

E arrange di firewood kon kut di melu put on-top. Den e sey, “Make una fetch wota put for four gallon kon pour am on-top di ofrin and wood.” So den do as e tok.


So King Ahab go chop and drink and Elijah klimb go Mount Karmel. E bend kon put en face for en leg centre, den e kon dey pray.


So Moses and Joshua wey dey follow am kon go di mountin, den Moses klimb go meet God.


E nor go tey again before una go si one good king wey dey rule well with one kingdom wey big and wide well-well.


My savant grow like seed wey dem plant for dry groun. E nor even get beauti or respet wey go make us notis am.


Wen Jesus hear wetin happen, e komot der enter boat kon go where pipol nor dey. But wen pipol from difren-difren town hear where e go, dem kon follow am.


E take Pita, James and John follow body. E mind kon dey trobol am and e nor dey happy.


Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town.


Jesus nor let anybody follow am espect Pita, James and John, wey bi James broda.


Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.


Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.


E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan