Naw, wi dey sey, na pipol wey dey karry body up, happy pass. Wiked pipol nor dey only prosper, but dem dey test as God patient bi with di wiked tins wey dem dey do; yet nor-tin dey happen to dem.”
Afta Jesus enter di temple, di priest oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, “Na wish pawa yu take dey do all dis tins and who give yu di pawa?”
Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”
So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”