20 So di man kon go, bigin tok for di whole village about wetin God do for am and evribody wey hear am, sopraiz well-well.
Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
Many pipol from Galilee, Dekapolis, Jerusalem, Judea and pipol wey dey stay near Jordan River, kon follow am.
Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel!
Den Jesus komot from Tyre kon pass Sidon go Galilee Sea for Dekapolis aria.