Again, Jesus kon bigin tish pipol for di wotaside. Since pipol wey gada round am many, e enter boat dey tish di pipol as dem sidan for groun near di wota.
As Jesus kom down from di kenu, one man wey get demon for di town kom meet am. E don tey wen dis man wear klot or stay inside house, but e dey stay for beri groun.
As di boy dey kom, di demon trow am for groun, e start to dey shake and foam kon dey komot from en mout. Den Jesus kommand di demon make e komot and e heal di boy, kon gi-am to en papa.