Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 4:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 Den Jesus tell dem, “Why una dey fear? Una still nor get faith?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 4:40
10 Iomraidhean Croise  

E nor go break di wood wey bend or lite lantan wey nor good. En good judgement go dey di whole world forever.


Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Una faith small o-o! Wetin make una dey kworel with unasef sey una nor take bread follow body?


If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.


Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.


Fear katch dem well-well and dem kon dey ask each oda, “Who dis man bi sef? Even breeze and river dey obey am!”


Den Jesus ask dem, “Where una faith dey?” But dem dey fear and sopraiz dey tell each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wota dey obey am!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan