22 E nor get wetin pipol hide wey God nor go show and e nor get wetin dey for sekret naw, wey nor go kom out for open.
For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.
Bikos e nor get wetin pipol hide naw, wey God nor go bring out and wetin dey sekret naw, God go bring am out for where lite dey.
Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.
bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.”
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.