Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 3:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Bikos of di pipol, Jesus kon tell en disciples make dem prepare one small boat for am, so dat pipol nor go push am anyhow.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 3:9
9 Iomraidhean Croise  

Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon enter boat go Magadan aria.


Again, Jesus kon bigin tish pipol for di wotaside. Since pipol wey gada round am many, e enter boat dey tish di pipol as dem sidan for groun near di wota.


So afta dem leave di pipol, dem enter di boat wey Jesus sidan and oda boat still dey der with dem.


As Jesus just dey kom down from di boat, one man wey get evil spirit kom out from di beri groun, run kom meet am.


Na wons, Jesus know sey pawa komot for en body. E kon turn round ask di pipol, “Who tosh my klot?”


So only dem kon enter boat go one place where pipol nor dey.


Jesus stand near Gennesaret and pipol gada make dem for hear God word.


E enter inside one kenu wey bi Simon Pita own kon tell am make e push di kenu enter wota small. Den Jesus kon sidan dey tish di pipol from di kenu.


Since Jesus know sey dem go won take am by force go make am dia king, only en kon komot go on-top di mountin alone.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan