Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 3:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Di law tishas wey kom from Jerusalem sey, “Belzibub dey inside am” and “Na demon pawa e take dey drive demons komot from pipol body.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 3:22
14 Iomraidhean Croise  

For dis time, Ahazaya fall from en ofis window for Samaria kon bigin sick. So e koll and send messenjas kon tell dem, “Make una go meet Baal-Zebub wey bi Ekron god kon ask weda I go die or not.”


But naw, I don turn worm instead of man. Evribody hate and dey laf mi!


E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”


Wen John di Baptist kom, e nor chop, drink or enjoy life but una sey, ‘E get demon!’


But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”


Some Farisee pipol and law tishas kom meet Jesus for Jerusalem ask am,


But di Farisee pipol sey, “Na devil pawa Jesus dey use take drive demon komot from pipol body.”


Di Farisee pipol and some law tishas, wey kom from Jerusalem gada for where Jesus dey.


But some among dem sey, “Belzibub wey bi demon oga, na en pawa Jesus dey use take drive demons.”


One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.


Di time for di Dedikashon Feast for Jerusalem kon rish.


Di pipol ansa Jesus, “Demon don enter yor body! Who won kill yu?”


So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”


Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan