Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Di Farisee pipol kon dey look Jesus with korna eye weda e go heal di man for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 3:2
12 Iomraidhean Croise  

Wiked pipol dey set trap for God pipol, dem dey find ways to take kill dem.


I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”


So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite.


One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”


So Jesus tell di man, “Make yu stand for centre make evribody si yu.”


For one Sabat Day, wen Jesus go chop for one Farisee oga house, di pipol kon dey look am,


Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.


Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.


(Dem ask am dis kweshon to set trap for am, make dem for fit katch am). But Jesus bend down kon take en finger dey rite sometin for groun.


Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.” But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan