Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 3:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Plus Andru, Filip, Bartolomew, Matiu, Tomas, James wey bi Afaeus pikin, Taddaeus, Simon wey dem dey koll Zealot (pesin wey dey fight for en kountry),

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 3:18
27 Iomraidhean Croise  

“Nor bi di karpenter pikin bi dis? Nor bi Mary bi en mama? James, Josef, Simon and Judas, nor bi dia broda e bi?


As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.


As e dey waka for road, e si Levi, Afius pikin, sidan for where dem dey kollect tax. E tell am, “Make yu follow mi.” So Levi get up kon follow Jesus.


James and en broda John, wey bi Zebedee shidren wey Jesus dey koll “Boanerges (wey mean ‘Tonda shidren’).”


and Judas Iskariot, wey sell Jesus give en enemies.


Nor bi di karpenter, wey Mary born bi dis? Nor bi en brodas bi James, Josef, Judas and Simon? Nor bi en sistas dey with us so?” So dem kon dey vex for am.


Andru, Simon Pita broda, na one for di disciples wey hear wetin John tok kon follow Jesus.


So Tomas, (wey bi Twins) kon tell di oda disciple, “Make wi follow am go, so dat wi go die with am.”


Judas (dis nor bi Judas Iskariot) kon sey, “Oga God, why yu won show yorsef give us and yu nor won show oda pipol for di world?”


Simon Pita and Tomas (wey bi twins), with Netanel (wey en town bi Kana for Galilee), with Zebedee pikin and two oda Jesus disciples, kon gada togeda.


Wen dem enter Jerusalem, dem kon go di room for upstair where dem dey stay. Pita and John; James and Andru; Filip and Tomas; Bartolomew and Matiu; James wey bi Afaeus pikin, Simon wey dem dey koll Zealot and Judas wey bi James pikin, na all of dem gada for der.


Afta dem don tok finish, James ansa, “Awa brodas, make una hear wetin I won tok.


Di next day, Paul kon follow us go si James and all di eldas wey dey der.


Den e appear to James, den to all di apostles.


abi wi nor get rite to marry biliver for Christ?


But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda.


so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.”


Mi James, wey bi God and Jesus Christ savant, dey greet una wey bi di twelf tribes wey dey for evriwhere for di world.


Dis leta na from Jude, Jesus Christ savant and James broda. To di pipol wey God don koll, wey Papa God love don wrap like klot for Jesus Christ body.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan