7 “Why dis man dey tok like dis? E dey shalenge God! Who fit forgive sins escept God?”
No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.
But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu.
But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.
But even with all di sin wey wi kommit, Yu still dey forgive and sorry for us.
E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
Den di High Priest tear en klot kon sey, “E don tok against God! Why wi still nid anoda witness? Una don hear as e tok against God!
Den some law tishas kon dey tok to demsef sey, “Si as dis man dey shalenge God.”
Una don hear di word wey e tok against God! Wetin una tink sey make wi do am?” Dem kon ansa, “E suppose to die.”
So some law tishas wey sidan der kon dey tink wetin Jesus tok for dia mind dey sey,
At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis?
So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?”
But di pipol wey sidan dey chop with Jesus kon dey tell each oda, “Who bi dis man wey dey forgive sin?”
Di Jew oga dem ansa, “Wi nor won stone yu bikos of di good tins, but na bikos yu wey bi ordinary pesin, dey make mout sey, yu bi God.”
Why una dey tell di pesin wey God choose for ensef and wey E send kom dis world sey, Yu dey tok against God, bikos I sey, ‘I bi God Pikin?’