Zadok wey bi di priest with Levi pipol, wey karry di Kovenant Box, dey der too. Dem put am for groun, offa sakrifice and dem nor karry am again until all di pipol komot from di town. Even Priest Abiatar dey der too.
Di king ask, “Why yu sey make I give Abishag to am? Yu for still ask sey make I gi-am di throne too, since e bi my senior broda and Abiatar di priest and Joab dey en side!”
Di seketry, Shemaya wey bi Netanel pikin from Levi tribe kon rite dia names give di king, di ofisas, Priest Zadok, Ahimelek wey bi Abiatar pikin and di leaders among di priests and Levi family. Dem choose each family with di dice wey dem trow for Eleazar and Itama.