But as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwhere dey spread di story, sotey Jesus nor fit enter any town again, so e kon dey stay where pipol nor dey. But pipol still dey kom meet am from evriwhere.
Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.
Plenty pipol gada around Jesus kon dey waka jam one anoda, so Jesus kon tell en disciples, “Make una shine una eye well-well, bikos of di Farisee pipol wey dey pritend.
One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.
All di pipol wey skata komot from Jerusalem for di time wey dem kill Stefen kon travel go far place like Foenicia, Cyprus and Antiok, dey prish give only Jew pipol.