Di pipol kon sopraiz well-well wen dem si who nor fit tok, dey tok, who nor fit waka, dey waka, who blind before, dey si naw and all of dem kon praiz Israel pipol God.
Wen Jesus don drive di demon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz well-well and dem kon sey, “Nobody don si dis kind tin for Israel before.”
Afta dem warn Pita and John well-well, di Jew pipol kon leave dem make dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin happen so.