Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 15:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do?” But dem kon dey shaut more-more, “Kill-am trowey!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 15:14
24 Iomraidhean Croise  

Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi do naim make dem dey ponish us so. But dis man nor do any bad tin.”


but na with Christ blood and na dis Christ bi God lamb wey nor get any mark or stain.


Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven


But wen dem si sey na Jew e bi, dem kon start to shaut again, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!” Dem shaut like dis rish two hours.


Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am, dem kon dey shaut, “Nail am for cross! Nail am for cross!” Den Pilate sey, “Make only una go nail am. But as for mi, I nor si any bad tin wey e do.”


Pilate still ask am, “Wetin bi di trut?” Den e go outside again go meet di Jew oga dem kon tell dem, “I nor si any bad tin wey dis man do o-o.


Wen di soja oga si wetin happen, e kon praiz God sey, “True-true, dis man na good pesin!”


But dem still dey shaut, “Kill-am trowey, Kill-am trowey!”


Den Pilate tell di priest oga dem and di pipol, “I nor si anytin wey go make mi kondemn dis man.”


Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”


As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”


kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”


Even doh e nor do any bad tin or tok lie, dem plan to put am for grave with wiked pipol but dem kon beri am for rish man grave.”


Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.


Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!


Dem kon shaut, “Kill-am trowey!”


Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.


Even doh dem nor si anytin wey go make dem kondemn am, dem still tell Pilate make e kill-am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan