Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 14:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 14:1
23 Iomraidhean Croise  

Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.


Yu like bad tins pass good ones and yu love lie-lie pass trut.


Dem dey spend all dia time dey plan how dem go take finish mi. Dem dey happy to lie about mi. Dem dey praiz mi for my present, but for dia heart, dem dey curse mi.


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


God tell Moses and Aaron for Egypt,


Make dem grind am to pieces kon pour olive oil inside, bikos na korn ofrin.


But di Farisee pipol kon go plan as dem go take kill Jesus.


“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.


Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”


Dem sey, “Make wi nor do am naw wen dem dey do di Feast, so dat pipol nor go rayot.”


Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles?


Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.


Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan