9 “Make una shine una eye. Dem go take una go kourt and dem go beat una for sinagog. Bikos of mi, una go stand for govnors and kings front, so dat una go fit tell dem about mi.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
“Make yu nor tell anybody about wetin happen so, but go show yorsef to di priest. And make evribody for know sey yu don klean, make yu take di ofrin wey Moses kommand, follow body.”
Difren kountries and kingdoms go fight each oda. Eartkweke and honga go dey for many place. But wen di wahala won start, e go bi like wen woman won born.
If dem nor welkom una or listin to wetin una dey tok for any place, make una shake di san komot from una leg as una dey leave der, to show sey dem rijet di message.”
Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.
E waka kon meet us, take Paul belt tie en hand and leg kon sey, “Di Holy Spirit sey, ‘Na so di Jew pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon karry am give Gentile pipol.’ ”
Mi John, I bi una broda and I dey follow una share from di trobol bikos of di kingdom and dey bear di sofa wey dey inside Jesus. Dem porshu mi go Patmos Island, bikos I dey prish God word and tok about Jesus Christ.
Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.
I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.