12 “Broda go betray en broda make dem kill-am and papa go sell en pikin. Shidren go betray dia papa and mama and dem go kill dem.
I go make Gog fear mi kon ponish am with diziz. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.’ ” “Gog men go fight and kill each oda.
“Broda go sell en own broda give pipol make dem kill-am and na so papa go sell en own pikin too. Shidren go fight and kill dia papa and mama.
Many pipol nor go gri follow mi again and dem go dey lie and hate each oda.
Wen dem arrest una karry go kourt, make una nor worry about wetin una go tok. God go give una wetin to tok for dat time, bikos nor bi una go tok, but na di Holy Spirit go tok thru una.
Evribody go hate una bikos of my name. But di pesin wey go fit bear rish end, go dey save.”
Una papa, mama, brodas, rilashons and friends go sey dem nor know una and dem go even kill some of una.