Dem spread dia feada kon fly komot di eart and I dey look as di wheel follow dem. Dem stop for di east gate for di temple and Israel God glory kon kover dem.
God tell mi, “Man pikin, yu si wetin dem dey do so? Si di yeye tins wey Israel pipol dey do for here! Dem dey porshu mi komot from my Holy Place. Yu go even si tins wey bad pass dis ones.”