Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Mark 12:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Jesus kon tok to dem with parabol: “One man plant grape for en farm. E fence am round, dig where dem go dey press di wine put, den kon build big house wey guide go dey stay. E hire am give tenants wey go dey kare for di farm kon travel go far.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Mark 12:1
38 Iomraidhean Croise  

Wen dat time rish, di vineyard wey fine well-well and get one tazon vine wey rish one tazon pieces for silva, shuku-shuku go grow kover am.


I bin plant una like special vine wey dem make with di best tins. So na how una kon take turn wiked vine, wey dey produce bad grape?


But I tell God, “Oga God wey get pawa, nor let mi do like dis, bikos di pipol don already dey komplain sey dem nor undastand wetin I dey tok.”


E kon use parabol tish dem many tins: “Si! E get one farmer wey go plant seed for en farm.


“Wetin una tink? One man get two boys. E tell one, ‘My pikin, go work for my farm today.’


“Make una hear anoda parabol: One man plant vine for en farm, fence am round, dig pit where dem go for press di fruit wey dem go take make wine and build where sekurity go stay. Den e rent di farm give farmers kon travel go far place.


Wen harvest time rish, e send en savants go meet di farmers make dem gi-am en own share.


“One man wey dey travel kon koll all en savants divide en propaty give dem.


So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Den, Jesus sey, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”


E go bi like wen man dey travel go far. E leave en house make en savant look am, give dem work do kon tell di gateman make e wosh en house.


So Jesus kon tok to di pipol for parabol sey: “How Satan go fit take drive Satan komot?


E kon tish dem many tins for parabol sey:


“Afta sometaim, di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.


Jesus kon sey, “One big man travel go one far kountry where dem for won make am king and afta, e kom back.


Dem kon ask, “Na for where yu wont make wi prepare am?”


Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat “As dem dey look, dem nor go si and as dem hear, dem nor go undastand.


Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan