7 Dem bring di small donkey kom meet Jesus kon spread dia klot on-top am, den Jesus kon sidan put.
So each of dem kwik-kwik remove dia klot kon spread dem put for Jehu leg for di step. Dem blow di trumpet kon shaut sey, “Na Jehu bi king!”
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
Dem kon tok as Jesus sey make dem tok, so di pipol kon let dem go.
Many pipol spread dia klot for road and some oda pipol spread palm leafs wey dem kut from bush.