3 If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una sey, ‘Di oga nid am naw. Wi go bring am back leta.’ ”
Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.
Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.
kon tell dem, “Make una go di village wey dey for front. As una enter, una go si one small donkey wey dem tie for der, wey anybody neva ride before. Make una luz am kom.
So dem go kon si small donkey wey dem tie near one door for road and dem kon luz am.
E go show una one big room for upstair where tabol and chairs dey. Make una prepare evritin for der.”
Den dem kon pray, “Oga God Jesus Christ, na yu know wetin dey inside evribody mind. Make yu show us di pesin wey yu wont among dis two pipol,
Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.
and E nor wont make human being gi-am sometin like sey E nid anytin, bikos naim dey give life and air wey wi dey breath.
Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.