16 Jesus nor let anybody take anytin wey dem dey sell pass di temple varanda.
Wen dem rish Jerusalem, Jesus enter di temple kon drive all di pipol wey dey sell and buy for di temple varanda. E trowey di pipol wey dey shange money tabol and di pipol wey dey sell bird, e trowey dia chair too.
Den e tell dem, “Dem rite am sey, “ ‘Pipol go koll My house, Prayer house for di whole world.’ But una don turn am to where tif dey stay.”