Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”
“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.