4 For inside wildaness, John di Baptist kon bigin prish sey, make pipol leave di bad tins wey dem dey do, make e for baptize dem, so dat God go forgive dem dia sins.
“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
Pipol for Judea and all di aria wey near am and doz wey dey Jerusalem, dey go meet John and e kon baptize dem for Jordan River afta dem konfess dia sins.