Den e rish en village kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz well-well kon sey, “Where dis man from get dis kind sense and pawa wey e take dey do mirakle sef?”
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.