17 Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go give una pawa to katch pipol.”
For En-Gedi go rish En-Eglaim wota, pipol dey go der go katch fish. Dem dey katch difren fish for der just as dem dey katch for Mediterranean Sea.
As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e kon si Simon and en broda Andru wey dey trow net inside river, (bikos dem bi Fisha men.)
At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
James and John wey bi Zebedee shidren, wey dey follow Pita work, sopraiz too. Den Jesus tell Simon Pita, “Make yu nor worry, from today go, na pipol yu go dey katch.”