9 Herod kon sey, “I orda make dem kut John head komot, but who bi dis one wey I dey hear all dis tins about so?” Bikos of dat, Herod kon try to find out more about Jesus.
Even Herod nor still si anytin too, so e sey make dem bring am kom meet us. Dis man nor do anytin wey go make am die.
Wen Herod si Jesus, e happy well-well, bikos e don tey wen e won si am since e hear about am. E dey hope sey Jesus go do mirakle for en present.