Den as Moses and Elijah won go, Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.” (Pita nor even know wetin e dey tok.)
E ask dem, “Wi kommand una sey make una nor tish pipol about dis name, but si naw, di whole Jerusalem don full with di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?”
Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.