Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 9:44 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

44 “Make una nor forget wetin I won tell una, dem go sell God Pikin give human being.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 9:44
26 Iomraidhean Croise  

David ansa, “I dey for bad kondishon, but I nor wont make men ponish mi, instead make only God ponish us, bikos E get mesi.”


From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.


“Make una know sey na two days remain before di Passova go start and dem go give Man Pikin to pipol wey go nail am for cross.”


Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.”


bikos e dey tish and tell en disciples sey, “Dem go sell Man Pikin give human being. Dem go kill-am and afta three days, e go wake-up again.”


So evribody wey hear wetin happen, keep am for dia mind dey sey, “Wish kind pikin dis one go bi sef?” Bikos God dey with am true-true.


Jesus koll di twelf disciples go korna kon tell dem, “Si, wi dey go Jerusalem and evritin wey di profets rite about Man Pikin go happen for der.


But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am.


Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind.


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


Den Jesus tell dem, “God Pikin go sofa many tins: di eldas, di priest oga dem and di law tishas go rijet am, dem go kill-am and afta three days, God go wake am up.”


Jesus kon tell dem, “So una don bilive naw?


But I tell una all dis tins, so dat wen di time rish, una go remember sey I tell una about dem before. I just dey tell una all dis tins, bikos I dey with una since.


Jesus ansa, “Yu nor get pawa at-all for my life, escept God gi-am to yu. So, na di pipol wey bring mi kom meet yu, na dia sin big pass yor own.”


na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.


Make wi listin to wetin wi don hear, so dat wi nor go fall komot from di rite road.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan