Gehazi don dey go for dia front. E put di walkin stik on-top di pikin face, but di boy nor even shake body, so e kon go back go tell Elisha, “Di boy nor wake-up o-o.”
Jesus ansa dem, “Na bikos una faith too small and I tell una true word, ‘If una get faith wey small like mustard seed, una go tell dis mountin, “Make yu move from here go yonda” and e go move and nor-tin go hard una to do.’
Evil spirit dey worry am and e dey make am shaut. Di spirit dey shake am and foam dey komot for en mout. Di spirit nor gri leave am and e dey trobol am well-well.